Danfo Problem

Danfo Problem

Share

Contact information, map and directions, contact form, opening hours, services, ratings, photos, videos and announcements from Danfo Problem, Health/Beauty, Ibadan.

31/01/2026

Danfo Problem.

Las Las no need to greet person when you enter bus, na to just enter jejely siddan and mind your business.

Na so I enter bus , go siddan for back. Before I siddan , I greet the people wey I meet there but nobody answer me .
One yellow girl wey dey do like ogbanje hiss when I greet them . Another bros wey wear big polo murmur say make I siddan no be greetings we go chop. I hear wetin him talk but I do as if I no hear anything.

The way people be angry inside this bus this morning me I no even understand o.

Driver put on his radio and na news dey go on . On the news, dem dey talk about the killings and kidnappings wey dey happen for this country. One woman talk say her prayer for this country na make things change for good . Broda Big polo wey siddan near me tell the woman say e be like she no get prayer topic for her life coz as e dey so this country no fit good .

One guy man wey siddan for my front talk say left for him, make dem sell this country share the money even if na 5k reach him, him go usam go play 2 odds.

Oboy, na so inside bus take hot as everybody just dey talk their own mind about the country.

Meanwhile sister ogbanje , dey press her phone and she be hissing like snake . Is like she get anger issues coz the way she dey do, she fit bite person . Conductor sef dey his own dey shout for person head just because him want collect money , as if na his money wey passengers thief.
Driver dey dey drive like person wey his ancestors dey call make him ce join them .

Me I dey hate this kind bus wey everybody just dey vex for nothing, greeting sef wey you greet person na wahala .

31/01/2026

Danfo Problem

This life get as e share wahala give everybody , e no really get anybody for this life wey no get e own headache .
This evening , na im I realize say this my bald head na one of my biggest problems for this life wey I dey even though people say I be one person wey bald head fit well well . One guy even talk say God know why him make me bald very quickly coz my old picture when I get hair just be like I be half cast even though I no get shishi , I nearly givam slaap.

As I dey write this story, I no get myself , I dey update una my Waka today base on say una love my content and I appreciate una .

This evening inside bus , journey been dey smooth , nice weather , everywhere just cool and nice , perfect Friday to just reach house , baff and relax .
We don reach last bus stop , everybody dey come down , as e reach my turn make I come down , the guy wey dey come down before me mistakenly wave his hand for back and e nearly hit my face and as I say make I dodge am , na so I nack my hald head for the door , bl00d of zachariah , oboy , e be like make I kpai.
Next thing I just siddan back , close eyes, hold my head , as I hold my head , I just feel something wet as I touch am , everywhere stew , oboy , I want craze .
People just dey tell me sorry , sorry , I shout make them bring pure water come .. I use like 10 pure water wash my head there , my clothes all wet . Omo, for like 20 minutes , be like nepa take light for my eyes , everywhere just blur 🤒🤒. The matter long o but las las I gather myself reach house .

Since I reach house na lie down I lie down , headache want finish me 🤒🤒, this waka wey we dey Waka everyday no easy at all .

26/01/2026

Danfo Problem 💯

Bus wey I dey inside today go breakdown for road , the front tire burst loud like banger.
Driver and conductor come down to fix the tire ,as them finish fix am , agbero dun comot one of the tires wey dey for back carry go their caban wey dem dey siddan dey wait driver make e come settle them 😆😆😆. These guys are mean shaa.

Why you go comot tire of car wey no be your own and people dey inside the bus just because u want make driver give you money , how is this even right .

Driver, gently guy him go meet there to collect his tire but dem start to ask money and driver say him no go give them shishi , talk turn to fight , driver beat 4 of them . Na today I confirm say e get people for real life wey strong like jet-li . Be like driver do kung fu coz the wey him beat them , I sure say him Don stay for China before .

One of them use stick wipe driver for body, the stick break and driver collect the one wey break knack am for head and every where burst , na that one I pity pass coz e sure me say him go sleep atleast 5 days for hospital .
Lagos and e wahala no dey finish but I dey here for all the vawulence

26/01/2026

Danfo Problem 💯

Abegi oo pregnant woman , if your belle don big , no dey enter bus coz the katakata wey dey this Lagos especially danfo wahala , no good for una oo .
Wetin my eyes see today inside bus, I no want seeyam again oo.

Inside bus today , as I enter I siddan near one pregnant woman , her belle don big e be lîke she go even born anytime , I come wonder why she go dey enter danfo with all that stress .

As I siddan like this, I choke for that space coz the space too small, I just squeeze for there like say I dey inside sardine .

As we dey go , the pregnant woman start to do like she want born , she steady dey tell me to shift ,she even dey shout for me , she dey steady tell driver to drive small small , next thing she dey do like she want cry inside bus ... The matter tire me o to the extent driver vex and tell her make she no disturb anybody say no be him send her when she and her husband dey knack and e dey sweet them 😆

I come dey uncomfortable inside that bus e get one mama for back wey dey also shout for my head make I shift make the pregnant woman siddan well.. shift again how nah ?? Me wey dey suffocate .

As we reach the next bus stop o wey no be last bus stop sef, I tell driver to stop make I come down , I no fit continue that journey abegi , e tire me .

Want your business to be the top-listed Beauty Salon in Ibadan?
Click here to claim your Sponsored Listing.

Category

Website

Address

Ibadan